Test results two for suspected coronavirus cases for Ghana test negative, according to medical officials.
Korle Bu Teaching Hospital quarantine di two men wey dem suspect of de virus.
Head of Disease Surveillance at di Ghana Health Service, Dr Franklin Asiedu-Bekoe, tell BBC Pidgin say "de results of de test prove say both of dem be negative."
"We go like talk de public say make dem no fear sake of de virus no dey Ghana" he add.
Health officials say dem go continue to maintain preventive measures den ensure say de disease does no go enter de kontri.
Image copyrightGETTY IMAGESSuspected coronavirus patient
De two suspects who be men, report dema bodi to di emergency unit of Korle Bu Teaching Hospital for Accra on Wednesday dey complain of malaise, muscle pains and flu symptoms after one private hospital turn dem away sake of dema symptoms.
De Argentine, leave Shanghai for Accra in January dis year while en Chinese counterpart lef en home country for Ghana around September 2019.
Accra Secretary for Ghana Medical Association, Dr William Baah talk say de two patients dey inside isolated facility wey dem collect blood samples from them for further analysis.
"Dem develop symptoms which dey fit de case definition but e no dey mean say dem get [coronavirus] though" Dr Baah reveal.
Health officials say dem go take more samples from de two patients for testing on Thursday for Noguchi Memorial Institute for Medical Research (NMIMR), wey Ghana ministry of health give responsibility to screen suspected coronavirus cases.

Comments

Popular posts from this blog

Kamala Harris just showed why Biden chose her as his running mate

The media is pushing an evil and stupid agenda that I have drowned - Bisa Kdei

TV3 raids EIB Network for on-air talent again